Who dey UK Prime Minister Andy Burnham cabinet?

Wia dis foto come from, Getty Images
Andy Burnham dey announce im Cabinet afta dem swear am in as Prime Minister.
Di Makerfield MP, wey no bin wan tok about who e go choose, now don begin announce di pipo wey go help set di direction of im govment.
On Friday, di former Greater Manchester Mayor bin insist say e neva make any decision about im top team, but rumours still dey spread about who go occupy di top government offices.
Pipo believe say Mr Burnham bin dey consider either Energy Secretary Ed Miliband or Home Secretary Shabana Mahmood to bicom Chancellor, as many pipo expect Rachel Reeves to leave di position.

Wia dis foto come from, Anadolu via Getty Images
Earlier, Lord James Timpson bicom di first minister wey resign from govment bifor oga Burnham cabinet reshuffle.
Di former chief executive of Wythenshawe-based Timpson Group bin bicom prisons minister for July 2024.
MP Steve Reed also step down as Housing Minister.
For im resignation letter, di MP for Streatham and Croydon North say Sir Keir Starmer show loyalty to am by appointing am into Cabinet, adding: "I make no apology for returning dat honour."
Lord Patrick Vallance, wey im ministerial portfolio include science, innovation, research and nuclear, follow Lord Timpson resign.
E serve for both di Department for Science, Innovation and Technology and di Department for Energy Security and Net Zero wey Ed Miliband lead during Sir Keir premiership.
List of cabinet wey Burnham appoint
- John Healey don bicom Chancellor for Prime Minister Andy Burnham first Cabinet appointment.
- Ed Miliband don bicom Foreign Secretary.
- Shabana Mahmood go remain Home Secretary.
- Wes Streeting don confirm as Defence Secretary.
- Louise Haigh don bicom First Secretary of State, Chancellor of di Duchy of Lancaster and Minister for di Cabinet Office.
- Yvette Cooper don bicom Health Secretary.
- Pat McFadden go remain Secretary of State for Work and Pensions.
- Downing Street don announce say Bridget Phillipson go remain member of Cabinet as Minister for Women and Equalities for Andy Burnham govment, but she no be Education Secretary again.
- Angela Rayner don bicom Housing Secretary.
- Jonathan Reynolds don bicom Business Secretary.
- Lucy Powell na di new Education Secretary.
- Anneliese Midgley don bicom Chief Whip.
- Lisa Nandy go remain Culture Secretary.
- Alex Norris don bicom Lord Chancellor and Secretary of State for Justice.
- Dame Angela Eagle na di new Environment Secretary.
- Miatta Fahnbulleh don bicom Energy Secretary.
- Hamish Falconer don bicom Minister of State (Minister for Intergovmental Relations and European Relations).
- Douglas Alexander don return as Secretary of State for Scotland.
- Matthew Pennycook go remain Minister of State for Ministry of Housing, Communities and Local Govment.
- Alan Campbell go remain Lord President of di Council and Leader of di House of Commons.
- Baroness Smith go remain Lord Privy Seal and Leader of di House of Lords.
- Emma Reynolds don bicom Chief Secretary to di Treasury.
- Stephen Kinnock don bicom Secretary of State for Wales.
- Heidi Alexander don return as Secretary of State for Transport.
- Ellie Reeves don bicom Attorney General.
- Chris Bryant don bicom Secretary of State for Northern Ireland.









